Naija Pidgin Challenge: why I like steemit.

in #npc7 years ago (edited)

028.JPG

Omor gist full o, if you look my face you go see say joy dey am over. I go try do am sharp sharp so that I no go too take una time.

  • First first, since i come steemit the things wey I don sabi don plenty, especially crypto waka and poetry things. Me that year wey no even fit read two line of book, see as i dey chop boku writings for steemit wey don do make my sens update. dey remind me of that olamide song.

  • The love and new friends wey I don make for steemit, I no get am for any other social media I swear, just dey go meetup and things, dey see people , dey interact and any support wey man need na so so solution steemians just dey give person, this men try well well, including the big boys wey dey try show us way, them make us feel like say steemit na our village, I never see this kind love for anyother place

  • Towards the end of last year, things been hard well well oo, based on recession and this APC government , prices of things dey rise but income na the same, na so my hommie come tell me about steemit o, even tho we never blow like dynamite, at least boys wallet don elevate, we get money to invest and take care of some important things for street, all this from to dey yan about things wey you like ooo, e too go well abeg.

  • Now my spare time no dey waste o, na steemit all the way. I don dey more productive dey manage my time wey wey sote even my spare time dey make me money.

Omor I too like steemit, infact I die put inside o, lol.
Baba God bless Steemit founders wella, bless @ned and over bless @ogoowinner based on this challenge wey she carry come, Amen!!!!

Sort:  

Nice post, if you are interested in our whatsapp group chat
1: upvote this comment
2:follow me
3:reply yes to this comment
4:join our community of mutal upvoters
see u at the top: https://chat.whatsapp.com/2w7MBjGYh2I9Li4rg0EYHF

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by davidekpin from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 64302.59
ETH 2654.83
USDT 1.00
SBD 2.83