A STEEMIAN'S WORST NIGHTMARE:I DEY VEX(I AM ANGRY)

in #stach7 years ago

I have vex oh,am sober oh,i go blow whistle oh.

My people,i dey greet una,this afternoon as i just dey gist(talk) with my people dem,i dey even laff pesin sef,na ein i say make i just check my blog see as my posts dey grow,i shock as i see am,wahala gas oh,as i just dey scroll down,na ein i see say my money for my post don disappear,i no see dey money again,i no dey joke,i no see anything,i never vex that one finish,i still dey scroll,my people na ein i see another one,ds one weak me,my people,0.00 na wetin i see,.

People dey talk plenty,some say na network,some say na fluctuation in sbd price,some even get mind say na my village people dey work on my blog but one thing dey sure ,if i no see my money ,i go vex make another blockbluster post.

My people na me story be this oh,u fit come share your own but no forget to upvote,and resteem..make people sabi wetin fit happen.

Sort:  

Calm down o jare

Where your upvote dey??

I been the notice that kind thing too for my post
Thank God say @elizabethscarlet another person done follow see wetin I dy see

I don't even know whether to laugh or sympathize with you

Na small small... Easy on the matter

Sorry. Pele

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 64302.59
ETH 2654.83
USDT 1.00
SBD 2.83