A message to Nigerians (In Nigerian Pidgin English)

in #nigeria7 years ago


Source
I have come across articles written in Chinese, Arabic, Korean, German, etc which I have had to move to google translate, so as to be able to read them. This gave me an idea, which with the recent invasion of Steemit by Nigerians, I hope on experimenting with, although I am not sure as to as how it would be accepted. I will be writing the rest of this article in Pidgin English as it is the "Language of Nigeria". While this might not really get the desired effect, there is no harm in trying. Afterall, I be Naija pikin and I no go fit use left hand describe my papa house.
As I dey stroll for the Nigeria tag today, I dey observe the posts wey people dey drop and the comment wey dey follow them. Naso I start dey see say my country people dem don dey use our own pidgin dey yarn and the thing just dey sweet me for body. Na the main koko, wey I reason, come start dey use pidgin write so.
Make every body wey dey read my work help me give our Naija curators, wey dey runs "Project Bigwaves" better gbosa as I don dey observe say every beta work wey carry the Nigeria tag for head don dey gather better upvote and better rewards and na now I come dey observe say Naija people plenty wela for Steemit. Before this project start, everybody don dey form Oyinbo for here, we no even dey follow awasef yarn anything at all. Na the Oyinbo people dem we dey follow reason but my belle don sweet now based on say everybody don calm down for Jesus and we don start dey do normal. See, wetin go make you come siddon here mean say una no dey do yahoo as per say normal person wey dey do yahoo no go get time come siddon here dey reason wetin hin go write, wey go give am beta reward. For that kind person, Steemit na long thing and by hin own standard, "No time to check time".
If we reason am wella, Steemit na better site, wey we fit dey use gather better money, wey SARS no go dey pursue person. If you jam better money for here, you go fit dey gallant, take face SARS on top your money (Make una dey careful sha, SARS dey shoot before den ask for tori these days o). At a point sha, person go get peace of mind, you no go dey jump enter bush if you sight SARS or hear siren as you dey waka for road.
For una wey just dey join Steemit, I go like give una small advice wey go do you better if una reason am. Make una no dey do copy copy if una no wan enter wahala with @cheetah and @steemcleaners them. I dey do better copy copy wella on top my former account wey be say den finally do me strong thing, come ban me. Na the new account wey I just start dey use be this.

Source

Another advice wey I go like give una be say make una no dey spam person work. That kind thing dey vex person and some kind people fit flag you on top am.

Source
I don wan forget, the main koko wey everybody dey do for Steemit na to dey drop any kind work, wey fit be photo, Video, article and other things wey una believe say una sabi do wella. No come reason say una go fit dey drop anyhow yamayama for here, people wey dey here no be mumu and na only beta work dem go fit dey upvote, to dey give you money. No just dey drop wetin sweet your belle drop, dey observe wetin your followers dey gbadun, make you dey drop am sef.
Brothers, on behalf of we wey don dey here before and on behalf of our country, I dey beg all of us, make we no come do anyhow yamayama for here o. I dey use God beg all of una, make una no carry yahoo enter here o. No come spoil market for us wey be say we dey rack our head dey put better work for here, I dey take God beg una. Naija no too get better image for these people front and now, we get chance take repair our country name for here. Nobody wey get Naija blood fit dull, So I dey beg una, make una dey try stress unasef small dey drop better work for here. I swear, na that kind money dey sweet spend pass.
I get believe say we fit make am for here, na make we put hardwork into wetin we go do and nothing go fit to stop us.
If una gbadun my work, make una upvote me and if una sabi other people wey hin go dey useful for, make una resteem am. Una go fit follow me @illuminatus.

No matter the reward I get, it actually felt good to write this.

A billion thanks to @elyaque for this incredible badge

Sort:  

If to say you don wait 24 hours after your last post, you for don get all dem big votes untop this wan sef but e no mean say I no gbadun wetin you talk. @fisteganos sef get one post wey e write for pidgin. Carry dey go bro.

I reason say make I sharpally drop am ni jare, Before people go enter church come back, other feeds fit don cover my feed. You do well brother.

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63626.66
ETH 2640.26
USDT 1.00
SBD 2.75