CELEBRATE THAT WOMEN WEY SPECIAL AND WIN RECHARGE CARD JOIN.

in #contest7 years ago
Una good morning my country people. Today na Thank God it is Friday as oyibo people dey talk am although me never know why na only Fridays Dem dey thank God but dat one na Tori for another time.
E don tey wey we do contest for we blog and I know say una phones dey cry for recharge card na im make the good people of naijapidgin come decide say wetin we go do to make una smile again?

imagesource

Yesterday na international women's day. Everywhere you go the news full ground so today we for Naijapidgin still want celebrate women and that na im be today matter.

Wetin we want make you do?

Just upload a picture of any special woman for your life. E fit be your mother, your sister, your friend, your lover sef. Just upload the picture den write one sweet message to wish am happy women's day.

As usual, na for our telegram page by 9pm this night we go select winners wey we go sama their phone with recharge card.

Wetin you dey wait for?

To participate, first upvote this post and join us for our telegram for here

na @zizymena na im bring this one come una domot today.

image

Na @mittymartz na im design our avatar.

if you dey drink today, make you no drink drive o because life no get duplicate. Una good morning.
Sort:  

IMG-20180222-WA0002.jpg
More love sis.
Na u all the way, e no make sense if I no celebrate u.
Chop up,shine on , make u keep everything on for its ya day.

No forget say na me wan pay d bill.. Lol

Momi Adebisi 2 20180309_084138.jpg

@ my people for Obodo Naija pidgin, i drop my salutation o. And thank God it's friday, i pray say this weekend beta go follow us, money go follow, us and favour go follow us.
Well since yesterday na women's day and today we de send shout out to special women for our life, so i wan take this time take celebrate this special woman.
She no be my biological relative, but this woman special to me pass even some of my biological relative. She get mind like gold, caring, God fearing and most of all she be mother material. I just wan use dis opportunity take tell her say she too much.

Na your wife be dis? Una too resemble.

Haha... Na the husband be that. Both of them na very special people to me but since we the talk of women na it make i no talk about the husband.

IMG_20180101_180454.jpg
Na my kid sis be this, the love wey I get for her na unstoppable

See as she fine. This one na future miss world.

My people i hail ooooo...🙌🙌🙌🙌

We hail you too you @sweetestglo-eu. Body sweet us to see you for here.

DQmemcdutNte8RwKfRQKQ3WnjEuBZDBEvwxCtxcv6sMUWdF.jpeg
You are more than a friend or a twin or a sister to me. You are my mirror, when I smile you smile, when I cry you also cry. I wish I can spend just one more day with you. I miss you so much Kimora. Happy International Women day.

This thing wey you write sweet o but e for sweet pass if you talk am for pidgin

You be my bunky, my padi padi, my sister, my mama. If I dey look you, you be like mirror. When water dey my eyes e go dey your own too, when I dey shine teeth your own teeth go dey shine too. If I fit go market carry money buy one day with you, I go go bank go borrow money buy am. Kimora, I miss you die. Happy international women's day

My people well done o...i hope say una the enjoy una day...
As for me o, i dey office as usual...
I hail mama @ogoowinner. @zizymena and otjer people wey the carry this tori come..na God go bless una..

I wan wish my one and only mama a happy women day celebration..na she be the only woman wey understand me, she no fit break my heart...she dey ready to accept me anytime, anyday...
Moma...i love u scara

BeautyPlus_20170514125039_fast.jpg

Na this one sweet me pass. chai

My baby i sight u

I greet una, great people of Nigeria, the land wey dey flow with milk and honey, I salute una.

Naijapidgin una do well for this one wey una put for ground today.

IMG_3277.JPG

Mama mi, words no fit express the love, pain and sacrifice you don pass through because of me, I never see wetin go happen wey go make me fight you.
The love wey you get for me no be here, se na when you carry me for belle for good 9 months, Abi na wen they use razor blade caught your body make I fit come this world, Abi na when you almost kill yourself just to save me from electric shock.
Abeg I go continue they cherish you mama mi, nobody fit take your place for my life. May baba God protect you for me because I never do anything for you.
Abeg make una put una mama as num 1 for everything wey we dey do, death no go kill our mama for us in Jesus name ooo..... AMEN

This one too sweet me o. Chai. Me owe you something.

thanks very much.

PhotoGrid_1513335356110.jpg

Na me be this o
I dey celebrate myself in mama style

wow see angel, lovely pic DEAR

See as you fine make sense

I don book this space.

Space Booker where your special woman?

My pipu I trowey salute o.
catch the salute if you fit.
nobody fit dey as especial as dis epitome of beauty.
when mama no dey,she dey
when papa no dey ,she dey
when aunty no dey she dey.
when friends no dey she dey
she be like everything to me .
IMG_20180120_212341.jpg