Naijapidgin Hot seat with @Sussan... episode 9

in #naijapidgin6 years ago (edited)
@naijapidgin: my people my people, my country people, my ogbonge people for steemit. Una welcome. I just dey smile for here because Belle dey sweet me well w ell on top the visitor wey we get for we naijapidgin and even as I dey talk he just dey laugh dey look me. Chai but how person take fine laidis. This na full package. I no fit close mouth abeg make una join me welcome this hot babe @sussan

IMG-20180517-WA0021.jpg
@sussan this your blush I no understand oo

@Naijapidgin: How you de mama.... I still de trip for that your picture yesterday

U just too fine
@Sussan: Lol...you follow for people wey dey call me mama? Me na babe o

I for like make you trip for me too, no be only my Picture

@Naijapidgin: If babe don fine too much na mama I de call them
You mean am

No problem... I no de like pass boundary but as I see green light now.. I de come for you

@Sussan: Thank God say light no dey disturb your eyes, dey come abeg
@Sussan: Lol, ok, no wahala

@Naijapidgin: Aii make we enter business of the day

@Sussan: Thank God say light no dey disturb your eyes, dey come abeg

@Naijapidgin: Watin be your name... Like who be Sussan?

@Sussan: Sussan na my name everywhere, as you see the spelling so, na so E be everywhere. Na wetin my papa and mama dey call me

I be person wey just like humble learn new things and try too

@Naijapidgin: Issokay but you just break my heart
You know even wan know my own name but I go tell you

@Sussan: No vex I been think say as I no ask since I go ask later
Cos e dey my mind to ask now now

@Naijapidgin: Where you hear about Steemit

Who tell you?

@Sussan: I just dey one WhatsApp group wey dey discuss cryptocurrency dey observe. And na @samstickkz invite me come the group. En just come one day say, see wetin he find, make we try am. Na so I take hear am

My account no gree approve sharp sharp around March. Na july wey I come try again and e work

@Naijapidgin: Na so better tin be... E na de easy

This samstick sef I go like know the guy... Better tin too de attached to the guy.... But today na about sussan 😉

@Naijapidgin: What be your steemit challenges so far and watin de keep you going because I no go lie steemit hard 😟

@Sussan: Na better person wey e be

My own na say steemit need plenty time and dedication, and I get plenty other things wey dey draw my hand. So e dey stressful to dey keep up.

Wetin dey keep me na my friends wey I make since tey tey o, I no go lie.
E dey get sometimes when I go just wan waka but I don get plenty better friends wey be say na lifetime something so I go just stay back dey Try small small.
But mostly My Oga for life, @ejemai, big man wey get big heart, na im dey help my life for steemit. I no sure say I go still dey steemit if no be for am. I dey very grateful to am. Na him wey I know

@Naijapidgin: Awwn

@Ejemi.... That guy wae de handle stach

Mama you know people ooo

@Sussan: I been try to make friends early, na weyltin save me

the correct spelling na Ejemai* 🌝

@Naijapidgin: No vex Ejemai

@Naijapidgin: Yesterday steemit.com hit 1million..... How you think say e go help the blockchain

@Sussan: When e com to company or organization na plenty customer or users be the koko. So I sure say na positive things wey e go bring come.
World population na billions, we still dey million, we still get plenty space for more people

@Naijapidgin: I no understand

I no Sabi book like that

@Sussan: Wetin I mean na say na better thing happen to us, wetin we want na make people sabi steem worldwide, make ppl dey relax to use am. We fit even use am pass oga bitcoin. So make more people dey come. Space dey

@Naijapidgin: Oshe baby

I feel that one

@Naijapidgin: You be student?

@Sussan: Yes Sir

@Naijapidgin: Ghen Ghen

How you de manage school and steemit

@Sussan: Na wetin I been talk say plenty things dey draw my hand. I no too dey active for steemit now as I dey before. Na why I still dey grateful to my boss wey dey encourage me

I go soon finish come face steemit well well

@Naijapidgin: Correct babe

The money too de motivate you na

@Sussan: lol You eh.... At all at all na im bad pass my brother

@Naijapidgin: 😘
Enjoy jawe

@Sussan: I dey go open your case after ds interview

@Naijapidgin: You de different communities for steemit abi

All those @genesisproject, @stach, and so on

Which one you de and how them de help you

@Naijapidgin: You don already talk am na. They plenty. @Stach, @Steembees, @Euronation, @Genesisproject and @airhawk partially

@Naijapidgin: U de all this ones
.... Chisos

@Sussan: E no stop there but na the ones wey I dey show pass others

@Naijapidgin: How all this family de help you

@Sussan: Yes o
Naija ppl dey take community dey survive for steemit

@Naijapidgin: Na so....

@Sussan: I don sabi plenty ppl for those families and e dey give me joy.
Plus when e come to contest I sure say I get ppl

@Naijapidgin: Tell us those people

I know two now
@Ejemai
@Samstick

@Sussan: Another thing na the gist wey dey flow for the groups, i fit dey gidt for group forget to write post sef

@Naijapidgin: E don happen to me today ooo

I Neva post but trust #sttp or zappl

@Sussan: I no fit call all of them o, but make I try. @ejemai @samstickkz @ehiboss @ogoowinner @gee1 @prechi @destinysaid @ewuoso @amec @evelyniroh @tojukaka @sweetestglo @anniben @honourmaus @smyle @eurogee @japfive @pangoli @⁨Turpsy⁩
Me sef don tire. The names reach to make post

@Naijapidgin: 🤣🤣🤣🤣

See connection

Your future bright ooo.... Na connection de do am

@Sussan: I get plenty friends jare and most of them don help me in one way the other. Even if say steemit shut down today I know say wetin I get pass

@Naijapidgin: Confirm

@Sussan: Lol
Anyone can connect with anyone jare

@Naijapidgin: I just go your blog now.... You de write fiction wella
How VA that niche...e sure?

@Sussan: Na before wey ppl dey read post wella, I no sure say e go well now

Steemit has changed. Gone are the days whales see post and upvote. So I just post for fun and so dt there would be something on my blog

I'm not sure many ppl curate fiction...... Not sure sha

@Naijapidgin: If girl don de speak English
.... She don de get heart break
I gat you babe 😭😭😭

@Sussan: Lol. I typed it so you won't add it. Besides, my Pidgin is not really fluent. I'm not good at it

@Naijapidgin: Durh.... I am enjoying it

But you no de enjoy yourself
Or make off the AC

@Sussan: Lol
No off am o....... Lol

@Naijapidgin: You don ever experience cheetah or steemcleaner

@Sussan: No

@Naijapidgin: Correct babe... Keeping clean shit

@Naijapidgin: We don de reach the end of the interview

@Sussan: Ah for like continue o

@Naijapidgin: People don de find love and heart rub for steemit

Some say na venus be Dia own
How VA you na
Even if na crush
Let us know

@Sussan: Lol...love dey Everywhere

@Naijapidgin: Answer question abi you de shy

@Sussan: Ppl wey I dey crush on plenty make we leave dt one

@Naijapidgin: Who be the special one

@Sussan: E get one person wey dey make me jolly. @coachlovemore
Even though say plenty fine girls dey steemit and dem dey distract am but I know say last last na me be the biggest shareholder

@Naijapidgin: My heart don pieces

I think say na me

You fit tell us that tin? 😉

@Sussan: No 🌚

@Naijapidgin: Oya drop shout out for three people wae you like to seat for this hot seat too

@Sussan: Lol

@Sussan: @jblsignature @enoye @sweetestglo_eu

I love una and una beauty dey high me


@Naijapidgin: Thanks for your time @sussan

On behalf of naijapidgin... We are very grateful for making out time for this

We love you
@Mittymartz loves you more even if you have steemit....... Cough.... That all

@Sussan: Thank you very much.
I enjoyed the show

Naijapidgin: 😉😉

@Sussan: Lol...
My love-0-metre says it's not true

@Naijapidgin: Okay

Time will tell
@Sussan: Yep

Brought you by @naijapidgin, interview by @mittymartz


@naijapidgin will welcome every form of support to keep the community moving forward......
So who is going to be on the hot seat next week @*************........ we will find out next week same date and same blog 👉👉@naijapidgin #winks

Avatar by @mittymartz
IMG_20180319_092844_398.jpg

Sort:  

This hot seat na helele oo...

see as @sussan come fine like semo were they just Comot for fire.........

Na real helele

If you see as @sussan de shake for studio... Make I no just expose her

Shake wetin?
Make I no talk o

Lol..
Chai

This one na obonga interview oo,
Una Don try well well.

Thanks you jawe.
We no fit do am without una

Better interview..
I like am... Unah try.

Abey @sussan we need to rob mind oo..lol.
I just finvsay you be bibliophile 🙃..

My love for Dem eh no be 20naira own oo..

Guy borrow brain

Me and she don get agreement

Make I hear..

You be sapiosexual??
Because if you no be, den sorry ok..
She will go leave you, for me..

Bibliophile and sapiosexual dey join body together..

for real?
I'm waiting for your text

It has already started 😁😁..

Lol. i dey feel una. E con be like say i dey the same interview room. Correct!

@sussan, i dey greet o.

Keep it up guys.

Tank you my oga

Na God de give knowledge

When una wan interviere me na

Na God

Thanks for stopping by

Lol. This is cool. @sussan na fine girl o.

Lol...tnx

@sussan and @mittymartz I see you.
So @sussan you dey pass this guy greenlight abi no wahala we dey watch oh.
Ehen as I dey read una interview nah now I understand the reason why @sussan don.dey very scarce for the land
She get plenty things outside steemit.

Chai thank God for brother @ejemai hand for ur matter.

We dey pray for ur studies make u finish sharp sharp come dey show us great things for ur blog, ur studies is settled.
Chai chai this one make me jolly @coachlovemore and @sussan bin dey biggest shareholder e men sense scatter.
Nice interview jare una too much

Lol
@eunireal
I no fit shout

Great interview @naijapidgin. Good to see you interviewing such long standing steemian @sussan. Hmmmm, now I sabi who get @sussan heart.

I still have my heart with me o

Nice one... I feel the interview. I just day imagine @sussan with the pidgin thing. Lol

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63439.39
ETH 2545.40
USDT 1.00
SBD 2.66