YOU WIN BETTER MONEY, HOW YOU GO SPEND AM?

in #naijapidgin7 years ago

oaEY5Y9.jpg
Naija i dey hail oo
Una wehdone oo
Naija pidgin don carry another ogbonge matter come again...

Una know say things hard for our country,
Countri people dey find how dey go take survive,
Job no dey, money no come dey to start business.

I come dey watch big brother naija for night, i no dey watch am before but i just say make i watch am,
My paddy tell me say na 45 million naira wey dem go pay the person wey win, and wen dem dey ask the housemates wetin dey go use the money do, most of them no fit give better answer.

I come dey wonder, for this change wey things hard,
How person go win that kind money and e no go know wetin to carry am do?
Make una help me reason this matter oo

My neighbour come dey gist me how our naija youths dey throway money for club,
Say if you enter club for Friday, our youths dey throway money for ground people come dey pick..

Naija pidgin, help me reason this matter..
If you na you win this 45 million naira wetin you go carry am do

you go carry am go club as our youth dey do?

If na business you wan do
Which kind business be that?
How you go take make your life better?

Make una helep yarn o, I wan hear una tori today.

We get whatsapp group where we dey yarn everyday, you fit join us here

**MAKE UNA NO FORGET TO UPVOTE, COMMENT AND RESTEEM THIS POST, SO THAT YOUR PEOPLE GO FOLLOW CHOOK MOUTH FOR THE MATTER.

Na @nmalove bring this matter today..

IMG_20180215_155325_695bbbbb.jpg
Na @mittymartz design this ogbonge avatar

Sort:  

Plenty things dey to carry 45million do. From wholesale trading to opening pump station, to supermarket or invest in online trading or u even carry am learn work... 45million u Don go school dey work for oyinbo land, if u young sef u further for any sporting career you like.

Anybody wey get reach #5M cum poor again no been dey ready for this weekend life. On the contrary e small too lol cos Mayweather spend over $120M for club for one night..... But we fit understand with that one. No be money he d find again

My country people for Naija (#45M) na average money oo because for other country, you get the basic things wey you need to live better life and wey go help you do better business wey be say your capital no go disappear.

For my country Naija if you no take time, the whole money go disappear and you no go see your initial capital talkless of profit.
If I make the (#45M) na to open small average petrol station with (15M) outside of Lagos ni ooo or at the outskirt where I go fit see cheap land. Then go to my village and cultivate hectares of land for rice and cassava (5M) in mechanized farming with home made rice mill to process my rice products...Na to dey sell my packaged rice abroad like baba Obasanjo.

Then go to Osun state to look for cash crop plantation like cocoa,rubber,oil palm and kolanut (10M)and invest in that for the future.
Then go into snake business like Burutai with (8M) and use (2M) to buy some average shares.
Then jollificate with myself and my family with the remaining (5M).

My pipu una weldone o.
I hope say una dey set go smoothly and Jejely.
I get plenty plans to use the money do o.
I dey wait make the money first.
45 million Na come chop money?
Abeg make the money come First

Congratulations @naijapidgin! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.

To support your work, I also upvoted your post!
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Upvote this notification to help all Steemit users. Learn why here!

My naija people I hail una o,abeg if na me win that kain money,d first thing i go do be say,i go remove tithe comot,I go kon use some open a small business,me wey be say i dey find capital do business before. I go kon give some to the orphanage people because dem say giver no dey lack and God go dey bless u more.

45million🙊🙊🙊
I don rich....
I go remove my tithe first
I go give my dad and mum the 5m way dey on top.
i go pay our school fee reach till we graduate.
I go con organise that writing competition for my school.
I go con buy plot of land bulid hostel for school area here.
I go buy bus and find driver, make he dey carry student dey remit monry for me.
I go buy car
I go buy plenty steem and power up, and become a big whale
The remaining money, i go keep am make i finish school.
I go con open fashion house if i finish school

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63592.23
ETH 2551.58
USDT 1.00
SBD 2.75