My Entry for the Naija Pidgin Challenge by @ogoowinniner

in #nigeria7 years ago (edited)

images (8).jpeg
Source

My people, una weldone o. I troway salute give allof una.

Today, me sef wan join the pidgin english challenge wey our senior stemian @ogoowinner troway open give allof us. I know say this challenge fit don pass, but I say make I still do am.

I wan write about something wey happen to me three days ago. If you be woman you go understand this tory beta.

Una no say as women our 'down below' dey open well well. E no be like them men own. And una also know say if woman no dey careful she fit carry something for body.

Na wetin happen to me be this.

Na so I dey my own jeje as the good girl wey I be naim my village people fire me arrow, sama me with scratch-scratch. I no dey use people toilet anyhow, that's why I no say na from spiritual transport the tin take enter my body.

Na so I carry my pikin three days ago dey go her creche when the tin hook me.

I look left, look right, see say people full everywhere, na so your girl con dey use style dance small small. Small time na so I nak my crotch area dey try kill mosquito wey no dey.

I no no say one mama don be dey look me one kind. I sure say she go don dey calculate if I don't enter small crase make she no how she go take rush the pikin from my back to safety.

Na so I look am too, come greet am with beta Queens English, put small 'phonee' join make she no say I dey normal:

" Good morning, ma. You look amazing."

Mama look me small bad eye but con conclude say I dey okay. Na so she continue her waka. Wetin concine me. But I no need person to tell me again to be careful before I land yaba left.

Na so I decide to blow bike instead (me wey dey do 5,000 steps a day dey trek before) rush go my pikin school.

Wen I reach back house, I rush bring out my pikin coconut oil con rub plenty for the place. E no reach five minutes the tin stop.

God dey wonderful sha. I don tell myself say bottle of coconut oil no go miss for my house again.

Na my tory be this.

Special Shout Out Go to These my Special People

@ogoowinner @tojukaka @enolife @jeaniepearl @tyrex @acidyo @adabless @naijapidgin @alexmejia @seugmi @goldeejay @floxycool

Abeg if I no mention your name for this list, please be patient. I'm coming. I still dey find ogbonge blogs them to follow.

Sort:  

Na so I decide to blow bike instead (me wey dey do 5,000 steps a day dey trek before) rush go my pikin school.

A very funny experience though and also not a funny situatiins too. I like the wey you use coded way treat yourself and the pigin too e enter well well.

Haha. Boss mi, I greet. Thanks for stopping by. I appreciate it and thanks for reading.

Dis tin make sense oh. Abeg, how I wan take join this challenge? e go make sense to show ourselves small for here

Lol. E go make sense die, my sister. Just start a topic then tag @ogoowinner. But I no know if the challenge don end self. I just do my own for fun.

Hahahah..okay
Thanks