THE CREED OF LIFE - Naija Pidgin Challenge #3

in #npc7 years ago

Goodluck-Jonathan-The-Trent-3-e1429216610141.jpg
Image is Goodluck Jonathan

My steemit pipu, I dey troway salute o, Una wehdone. Na @pope1995 dey folo una yarn so. Our madam @ogoowinners na beta hail I dey hail you unto sey you sidon reason this matter wella. Thank you for this thing wey u do, i don even copy am down come paste for wall for bedroom, make i for de carry eye see am every morning and night.

na my pidgin translation be this

I believe sey everybody don reach to hear, like and love themselves

I believe say every one dey equal

I believe sey this world big reach to carry everybody

I believe sey everyone na baba for one aspect of him life

I believe sey everybody dey special and u no fit find am else where

I believe sey everybody get him bad and good side inside body. My own na to make sure sey the good part surface and the bad part no comot surface

I believe say where person come from, where him de worship and him position for society, people just come de carry am for head to put some kind people behind for society. Me as i de so, i go be human being first and i no go allow, tribe, religion or class determine how i go treat people

Onyibo talk sey "do unto other what you want them do unto you" na dis one me de carry for head

I no go carry people based on who them be now, but wetin dem go be tomorrow

I no go put hand for business wey go spoil person name

I go make sure sey i understand dem

I no go allow bad belle control me at all at all

Before i leave this world, i go try do something keep wey dem go carry remember me

I no go allow wuruwuru and catata weak me

I no go allow fear catch

Mind get power, so me no go allow bad things de inside my mind instead better better things go de am so as to fine tune my mind for the right direction

I go make sure sey i no live fake life

I no sey if i put my mind do something, better go comot

I believe sey this life de like travel, so me go move jejely, i no go allow person carry me run at all

I believe sey we suppose live in peace

I believe say, if we get pass another person, we suppose to de give

I no believe sey we suppose to the carry other people for mind

I believe sey we suppose love one another

I believe sey we suppose mercy for others

I believe sey person no suppose do person bad come go scoot free, no matter who you be

I believe as we de live so for this world

I don gree for myself sey i go enjoy this life wey i de live so, no be to come waka pass like tree

I Nkeneabasi Friday Aniekan do gree to follow this creed until when grave don call me for appropraite time

Sort:  

Pidgin no be small

Take some imaginary @teardrops (smart media tokens)

Hahaha nice one @pope1995 ...cant wait to read more of ur posts , am new here and will like you to go tru my posts if u are less busy ..steemit it all d way ..

Hahahahahaha
I'll do just that
New with rep of 47🙋🙋🙋

pope u don try 4 dis 1, to write all dis kind tin 4 pidgin no easy.
Weldon

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63188.04
ETH 2570.49
USDT 1.00
SBD 2.79