Friendly Enemies; how my friend take Judas me.. a contest by @ogoowinner

in #npc7 years ago (edited)

IMG-20170801-WA0000.jpg
Back when ah still dey secondary school,I bn dey among d bad boys fr me set buh e get dz gurl wey dey totori my life buh I bn no know how ah go take yarn her..I con tell me friend d mata wey dey jonz my heart,he talk say he go help me tell d girl buh d tin wey me no know b say nah hin go toast d girl for himself nd he dey yarn me another Tory...I Sha go meet him ask say how my package nah hin con tell me say d wetin dey ground b say him no go fit tell d gurl buh d gurl never get bf say mah go try me luck...I Sha gallant go meet d ogbonge babe tell her wetin dey xup.. Dz gurl con clear me say how I go wn snatch my friend babe,I con ask which friend naso she mention me judas friend name..I bn wn cry buh d tear no gree come,I Sha take style waka comot buh d shame wey I bn feel dt day pass uncle Jonathan own...

images (2).jpeg

My people mah una beware of friendly enemies oo..I gree with me anty @ogoowinner say friendly enemies bad pass dz buhari regime...
And abeq no forget to helep your boy with boku upvotes and resteem