Pidgin Contest "The Creed Of Life@Ogoowinner.
I just discovered this contest organized by @Ogoowinner,so i decided to participate. Oh bob!! Na serious yann be dis one ooo.
MY ENTRY.
I sabi say evri pesin get right make dem see am,hear am con love am.
I sabi say evri pesin wey dey dis earth dey equal.
I sabi say this world wey we dey contain evribody.
I sabi say evribody get im own brain to reason better thing.
I sabi say evribidy get bad belle spirit and good spirit inside us and for me I no go allow that bad spirit spoil my life.
I sabi say all this race religion and social status na wetin dey reign nau becos of d yeye leaders wey we get they spoil society but I go remeber say i be human before class and race go join.
I go do to others as I want make dem do to me because people sabi "do me I do u well".
I no go para for people because of who dem be ,but i go para because I wan make dem betta for life.
I no go follow people do business wey go cause gbege for anoda pesin.
I go try know people wella before i judge them.
I no go allow amebo,bad belle or jealosi control wetin I plan to do for life.
Before I kpai,i go make sure say I do good for life make people dey use dat good thing remeber me.
I no go allow fear fear spirit too enter my body because this life wey we dey person gats dey strong for challenges.
I no go allow any dirty thinking enter my mind,I go replace am sharp sharp with things wey go give me peace because wetin we dey think for head get power.
I go always be myself, because I no even sabi form wetyn no dey or con dey live life wey no valid.
I sabi say I go die put any task wey dem give me and difference go gats dey.
I believe say dis life wey we dey na market so i go take am easy because no be competition and nobody go win.
I believe say peace of mind good.
I believe say e good make person help those wey no get.
I believe say make we forgive people wey offend us.
I believe say make we love one anoda.
I believe say make everybody get mercy because na only God mercy dey keep us till nau.
I believe say everybody gats live accordingly , no partial.
I believe say better people they this world.
I con make mind say na good things I go dey do take teach others so that this world go better for everybody.
I @stacey31 go abide by this "CREED OF LIFE".
Make una join body make we spread this creed of life tori everywhere.
Thanks @Ogoowinner for this initiative.
Cheers.