You are viewing a single comment's thread from:

RE: Introducing Gratitude Day

in #busy6 years ago

When nerds pray. My gratitude list is limitless.


Baba God I thank you for all the level wey you dey run for my life base on who you be.

Na you get power, Na you dey make every where good. Sometimes I no know wetin I go do or talk sef. Thank you baba.


Based on the thanking things; una name too plenty so Na group I go thank o. @Airhawk-project, I thank una for the way una take welcome me. @stach no be small thing una dey do for that location, more groundnut oil for una Biabia. @promo-mentors Na God go bless all una doings, una tight Noni. @steemrepair, ha I no go forget una. Una Don dey by me since it have tey. Omo @isleofwrite I believe una marra. Soft writers wey no work for the street just boku. #SteemitRamble; bomb people wey dey make me feel at home on a normal. Who dey again #newbieresteemday, @steemiansarena, #altruistic.... Om dem too plenty.

I thank all of una for the role wey una dey tidy for my doings. Una solid as far as I consign.

Sort:  

Hehhehehe hope members of @promo-mentors go fit understand pidgin
Mehn I love your way
God go bless all our friends yakata

Them go learn o. What to do Na?

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 56589.13
ETH 3005.25
USDT 1.00
SBD 2.16