WETIN I DO WHEN I SMALL WEY MAKE DEM DISOWN ME.

in #esteem6 years ago

image
Source WhatsApp

Another beautiful Thursday morning on top our ogbonge blog the one and only naijapidgin. Anyother one na beta counterfeit. My country people, how una dey? Our Muslim brothers don jollification finish even though naijapidgin felicitate with una, una no fit even send us small meat make we chop. Anyway, we believe say holiday don finish and serious business don start.

Today for we blog Sha we no go dey too serious. Oyibo talk say all work and no play na im dey make Jack wetin e dey make am. So on top that levels na im make me reason say e go good make we see wetin go make us laugh small. Wetin I dey talk about?

All of us get childhood stories. Those things wey we do when we small wey we take chop better cain or punishment. I sure say una still remember. Before una write una own make me first yarn una my own but make you no laugh o.

When I small I stubborn no be small. I chop cain wella. If I say make I list am this blog no go reach but I go tell una one wey I no go ever forget. So e be say when I finish JS 3 exam wey Dem dey call junior waec I come dey reason wetin I go dey house do for 3 months before SS1 na im devil come visit me say make I still books from my school library. Dorithy international school then no dey let person carry more than one book comot without signing. Na so I tell two of my girlfriends we come enter dey hide the book for stomach carry comot. I carry 9 story books then na so holiday start o body come dey sweet me.

I no know say school don dey find the books. My mind be say when school resume I go return the books but for where? E don well for me. I tell my brother make e no carry any of the book go him own school wey be living word academy because him school and we own dey share siblings. Na so my brother come carry one of the book go him school, e no do am he carry am borrow one of him friend e come be say that him friend na the younger brother to the library prefect for my school. Infact my country people, fear no let me complete how this story take end.

Oya now, I know say no be only me stubborn for small pikin. If you know that thing wey you do for small pikin wey make kasala burst oya yarn us make we use am laugh this Thursday morning comot cold for body.

Na @zizymena carry this one come una domot o. Oya now. I dey wait to break my rib with laughter. God go bless our hustle today o. Una good morning

Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

Sort:  

Your own off me shaa oo! My own no be say I stubborn oo just say some times, e be like say my head dey touch. My own be say one day like dis we dey summer break na. Na him I go park all the cashew nut wey I Bin keep since March. That day, I say go roast am.

I no know wetin come happen I almost wan burn the house. As my mama come back eehh, e dey her like say make she set me on fire.

Shaa e get one wound weY she gimme for hand wey be say anytime I see am, I go remember that day.

@vintageverve thank God say e no injure you. You know say when cashew hot if you use am draw for body na everlasting mark be that. Maybe na the everlasting mark the cain give you so. Doh😂😂😂😂

Lol @zizymena mama, so u stubborn like this too. Well, na blood e dey too, u know wetin I dey talk na ba 😀😀..

Well, my own still long too but I go shorten am small. Me and my younger brother no dey like go school. In fact then we hate school. Our papa himself like school o so we dey dodge school mostimes. Our papa dey work for one bank for onitsha and we dey stay for Asaba. So as early as 7am, popsi don move dey go office. E go remain me and my younger brother for house. If we nor won go school, we go just lock ourselves inside house till when students don dey come back from school, then we go come out make e for b like say we go school too. Sometimes sef, we go dogde go Gamehouse, stay there play game o till school go close.

We nor know say one man for the compound dey observe us. E con catch us one day come go report give our dad, the beating wey we chop that night ehhhh, e still dey my head till now.😂😂😂

Special shout out to @naijapidgin, ona get level sha.

😂😂😂😂😂 I just dey imagine the kind beating wey una go chop that day.you no want go school you no let your brother go school too.

Na slap I first chop o... As e slap me ehhhh, I begin look for key wey fall from my hand

This one make sense make i no lie... zizi baby i hail o...

Hahaha
This one na double whala for you oo zizy

Me k be gentle girl oo, i dey fear cain.

I remeber one day like this for my grandma side, i like play ehen!

That day rain dey fall, i con carry keg with my friend, we dey use am do motor for inside rain. Hahaha.
Na him one of my uncle just dey come... Oh Jesus.
Na the first time i chop belt for my life be that, i con confirm say belt no dey pain person. Hahaha
That day no funny oo, i just change cloth, cry and sleep ni oo

Hahahaha, so belt no dey pain person. You too still play rain play ba? That one still follow for wetin I use chop cain

Make i no talk pass the one wey i don talk make e no be like say na my own case worse pass.

Una dey learn sha, wetin be belt. @zizymena shey u remember dat old okada break wire. One long black coated iron, when dat one touch me. I confirmed the difference between black and white vision. Ordinary belt wey be like spanking for me.

My mama deceive me go lagos and abandon me there, na there my head pass come down

|Make I steal not still, please check to correct.|

Very funny ehn, I used to steal books from the state library in large volumes too during my secondary school days very well, in large volumes sef, but I sure do return them.
My school library is just a show glass, you can't do anything there, neither read or borrow book, those teachers sit down there and start gisting and talking, in a Library for God sake.

Bros good morning
You no sabi yarn in pidgin? ☺

I no too stubborn o! But you see my hair, no touch am. For my secondary school Tantua Group of Schools, Na only ss3 dey make hair but me I start from ss2. So by the time we reach third term, my hair don turn better Afro. For night before school, I go wet the hair use headtie, tie am use am sleep, before morning e go Don press down. Them flog me tire for the hair every morning, I dey stand for assembly but I still no cut am till I enter ss3

I for like tell my story, my own too plenty.

My stubbornness dey like Alphabet A-Z. Dem no dey tell person my name wey no know me for my street and school for warri back then.

Even people wey senior me dey give me chance cos i dey beat my elders join.

For cane mata, my own be like tablet. I dey take overdose everyday expect sundays. My skul na one kind funny school wey u fit help person collect cane. My nickname na Chairman then, I dey collect cane for 4 girls steady. Before dem start names of noisemakers, the class monitor go write my name first immediately he tear paper cos he know say i must talk. My case worse so tey even wen my name no dey list, i go still receive cane.

I remember one incident for primary 6, year 2001. I no talk ooo cos i wan change but my name dey d list. Me, personally no dey like wen person accuse me wrongly cos i no go gree. When dem call my name, I shock. I for the teacher drag am say i no talk. He come ask d class, the monitor and one girl wey no like me then say I make noise. The tin pain me, i sabi dust cane. I receive 20 strokes of cane for yansh and i no shake. Wetin be cane wey na koboko dey dem use flog me for house.

Omoh, after skul close. I go block d monitor for road, beat crase comot for him head. The monitor no come lesson dat day, after lesson close. I go block girl too, she dey with her two sister. I beat d 3 of dem join.

The next morning for assembly dem call me out, I know say dem don report me. I tell d director why i beat dem, them flog me 100 strokes and i dust am. Them know me for dat kind tin. After the flogging, I slap the monitor immediately for assembly. Na so i run jump fence go back home.

Dem gats come beg me to come back to skul cos wen dem investigate, dem find out say i no do d tin. Na why i vex like dat.

That was d old me sha, I am now a good boy and i no be like before.. But the stubbornness still dey small sha.

Your own get degree oo

Okokobioko, e don tey wey you bad o. Chai @yungchief na so?😥😥😥😥

To listen to the audio version of this article click on the play image.

Brought to you by @tts. If you find it useful please consider upvoting this reply.

Memories plenty but i go kip dem for belle.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.12
JST 0.030
BTC 70976.53
ETH 3850.58
USDT 1.00
SBD 3.48