TRANSFER RUMOUR,FEATURING C.RONALDO,REAL MADRID AND JUVENTUS

in #football6 years ago

The latest Transfer Rumour wey dey Trending Online Consign Former Manchester United Star-Boy and Current Real Madrid winch C.Ronaldo AKA Ororo.As we bin see the rumour online,Serie A Giant, Juventus, submit £88m to Real Madrid but Madrid never discuss with Juventus concerning the money first but wetin dey on board be say Dem [Juventus] and Ronaldo don gree personal terms,dem offer our oga ORORO four year deal worth £30m per year [that is: £550k a week].

To make matter worse for Real madrid fans,juventus don see better house wey dem go rent for am,as soon as say the deal complete without traffic.The house big to the extent the mansion get 200 rooms with 8 bed rooms,indoor pools,and two secret road to the villa wey go ensure calm ambiance.The money for the rent na £45k per day.As dem talk am for news,dem say the house na the most expensive house wey dey for this world[if no be lie be that].

Recently today,Real Madrid don launch their home jersey officially and Ronaldo no follow men Model am,because that same morning for interview,Ronaldo Yarn ''Since wey i dey small,i no go lie una,i dey watch juventus game well well,make i clear una now,because i don admit am and hopefully,if the deal go jeje,i go sharply commot for Madrid,period!''

The main koko be say,Ronaldo wan commot,E no dey happy for spain,people dey frame am for Tax fraud and the Gospel truth be this: Real Madrid go lose fans,Hin fans go support am For Juventus,Real Madrid no go be the same with am again,some of Hin friends go wan commot sef,and finally,Juventus go recover The money wey Dem spend to get am from Real Madrid within a week.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.15
JST 0.030
BTC 65738.35
ETH 2677.27
USDT 1.00
SBD 2.91