Snake wey go swallow millions. How una take see am?

in #naijapidgin6 years ago (edited)

My naija people I hail o. 


We don land again with another better tori. 

We here say snake swallow jamb money. Abeg, how dat one take happen? 

Why our yeye politicians dey carry us play like dis? 

Before na rat chase presido commot from office, now na python swallow jamb money. 

How una take see the matter?

Wetin we as youth fit do to take stop dis kind nonsense?

Wetin be the way forward for us?

Abeg make una dey make una contributions breif. No need for long grammar. Lol!


Source 

Our discussion go continue for our telegram group. Remember say na there everything dey happen. If you never join, join here

Our people for telegram talk say na dis people qualify to collect 50% of our liquid payout for the last post. @samiwhyte, @mittymartz, @oliverwilliams, @zizymena and @horlaide.


If you wan join begin follow make this kind decision, join us for telegram for here. We go dey start discussion around 10 pm everyday. But we fit adjust time to any one wey una suggest. 

Na @ogoowinner choose dis topic wey we discus so. So, 5% of the liquid payout na her own. If you wan win the next one, join us tonight to discuss wetin our next topic go be. 


Walahi, E no easy to pick this winners because everybody yan better for dat tori. We go dey use our telegram group (naijapidgin) to decide better. 

Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post.

No mind say ein small now, very soon e go big reach money wey our politicians dey share. Lol!  

Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem. 


Who fit make avatar for this account for us? Abeg show face. The other guy wey been say him fit do one for us, Abeg show face for telegram. 

Na for telegram we go dey choose our topics. First person to pick topic wey others agree with go get 5% of the liquid payout. 


Abeg all the naija pidgin lovers make do quick quick go join the telegram group for here.

Our Telegram: naijapidgin

Oya make una yarn am as e take be for una mouth. 

Una doh o! 

Sort:  

Snake wey dey swallow ego..

As Nigeria don dey today, nothing say freak me again because weetin my eye don see my mouth no fit talk am
Nigeria wey be say witch dey carry mirror do snapchat, witch dey disappear but dem no commot this country go better place like singapore ,south africa or saudi arabia , them go dey carry broom dey fly and u wan come tell me say this witch no fit turn snake go jamb office go swallow money, hahaha I laughter.

dis part dey weird oo

Sebi na bank una dey pay jamb fee , abeg wetin cash come find gio jamb office , dis people dey kid us o
D snake wey cone swallow no swallow #36,000 it come be 36million,, Govt.suppose sue dem both the chairman and evrybody wey dey there office dey work.

Ma suggestions

If not be say all this govt. people get hand for the work bcos I know say d matter don die down as I dey talk ,them suppose sue each and everyone of them to courth and sentence them life imprisonment
Where u put the money?
How snake take enter?
How u take know say na snake swallow them??

I swear them suppose blast them.
And something is appening here right now politicians+ govt+witch = fooled nigerians..

Government no go fit tal because na dem dey do am. d tin wey dey tire me be say dey o get shame to commot talk dis kind tin. Dey just fall hands for this computer generation wey we dey so, I tire!

Adeola Samuel:
See na God fit help us. Becos if we believe say youth won change tings my people I no fit lie you nothing will happen. Becos we youth nowadays are after money, woman and all this yahoo stuff. Pls at the age of 23 na him Obasanjo don dey rule naso some other leaders too. Pls do we have youth at the age of 22 as minster or in power. But we youth no won die everybody dey run for his head. B4 nigeria fit change is when all poor can stand for their right we fight for right that's when things will change but who won die. Nobody so we just they hope Nigeria go better. Na everyday we dey hear news. herdsman dey there oh, Boko Haram dey there now snake don they thief money again for Nigeria. Hmmmm I tired oh. FB_IMG_1517087554320.jpg

Frustruation wey dey the countri don make our youth to dey put hand for yama yama. But if beta person wey carry naija for mind win the election, naija go better.

better person nor go fit win o
you must join dis people before you fit win

When i hear the tori, I first think day na like joking stuff. Next thing, the thing don day trend for twitter so tay they even create account for am @nigeriasnake

Which kain story be that self. How they fit open mouth yarn that kind story for this age and century. Small time, they go say cockroach don chop all the money for Central Bank or mosquito no allow police do them work wella.

I just day wonder how outside people go day look us. Imagine say you won go collect visa and the interviewer notice say na Nigeria you for come. He go day look you like one primitive person.

They fit even give you aptitude test like:

If a money mysteriously goes missing, what probably happened?
A. Theft
B. Negligence
C. A snake swallowed it

Anyway, if una know anybody way day train that kian snake, abeg, make I know. I no won use am thief o. No for my guys them way go get alert and no go gree pay me my money.

I don talk finish.

Hahahaha! Shame din dey catch me for this countri. Dey don fall hands finish for wia oyinbo people dey. I sure say our brodas wey dey that side go dey shame to dey waka for road. As our countri be so, na Baba God go help us.

Sha this story just dey trend anyhow for Dis our country . The funny thing just like I been talk before be say last last we go still swallow the Tori dis officials dey tell us. After all some go say 'wetIn we go do'?
Na dere I come enter, but fezz make I tank you @naijapikin for bringing this tori come here today.
See the problem wey we get for this country plenty ehhh setey to remedy am we go need better hand of God for our matter. 😢
But mostly, e dey because na the wrong people dem dey put for dis offices. If u wan do finding, you go realize say the person wey dey handle Dis money issue for that Jamb office sef no fit even study anything related to handling(Business management and the likes) dis our money sef wey our people don dey use write jamb tire. 😂😂😂
So first ting I go advice make our naija government do be say dey should employ people based on qualifications and experience no be Dis slot slot thing everywhere wey come be the order of the day.
Make dem also tighten security level wella for all our institution wet get money matter involved.
And if dem no wan do like that make we remove them for office ooo put beta people wey go know watsup. How we go take do this one?
Make we get our voters card ooo so we go vote for the correct people were go fit handle this country's and our various states problems.
I also wan tell our youths make me join this 'not too young to run' policy ooo after all, we be the leaders of tomorrow as we dey sing for song and that tomorrow don land today.
Make we stand up and act, because we dey capable to lead and stop making only person wey fit be our great great great grand fathers/mothers lead us ooo Biko.
I rest my case. 😂😂😃😃😃

Na true talk, na because say better people no dey handle the office wey dem supppse handle, na e dey cause all these wahala for our countri. Everybody for government get slot for e generation. Make youth commot for presidency, bEtter youth we carry naija for mind, no be yahoo yahoo youth.

You try!

Oboi!!..naija don make me beta 4 life i swear. The funniest part be say the same people wey believe say snake talkes to eve no come believe say snake come swallow money...lol
I too love my country

Lol.. Naija we dey.

My roommate get person wey dey work for jamb, we call am yesterday. The lady talk say this tori happen last year, say the people wey jamb give contract to sell their scratch card, dem sell am finish come chop the money. Na e jamb people come call dem, come dey ask of the money, one talk say e househelp turn snake for night go wia e keep the money swallow am, the other one talk say thief jam am for road collect the money, burn em car. Na d koko be dis, make una no mind dose bloggers wey dey turn turn tori.

Wetin we no go hear for this country! Dis one be like nollywood. Abeg wetin dey come do d people wey dey give contract

I no know wetin dey do dem o. The lady no talk am. The money don go be dat.

Are you serious?
Lol my naija my naija.
Last last we go still swallow the nonsense story like d one our president been tell us about the rat Tori.

Omo, as i hear that tori, i shock! Which kin thing be this? Me don tire for this country self na em make me decide say i go leave this country go back my village before them go talk say na animals wan contest for the next election

If dem fit count animals join human population...
if dem fit allow animal to chop wetin man labour plant and cultivate
Tell me why animal no go fit contest?

Hahaha.. Abeg where your village dey, no be naija? I wan follow you gooo..

My village na for abia, e no be naija abeg...lol

Our naija country don turn to land of the comedians. Na so so we go dey disgrace ourselves for international community. This matter no fit happen if the country get ogbonge law wey dey punish offenders.

As for the youth contribution, we no fit start war for our country, na the best thing to do now is to sanitize ourselves and our country people on the need to elect better leader not minding tribe or race wey go get the mind of our country people for heart.

We don almost enter election year, make all credible youth go collect their voters card and jejely keep am for the election day. Na we suppose decide the person wey we want this time and we should pursue all those baba wey wan turn naija to their papa property away from the political scene.

ps :

I can't totally express myself using pidgin. Thanks @ogoowinner

You yarn better yarn.. Make our youths carry wetin dey happen learn better lesson, make we no fall our countri hand go vote person wey no go help naija. As election dey come, make dem tear eye.

Nawa o, the thing dey make me smile...how can snake swallow that plenty money. I no believe, i beg i sabi know how to chop no feed me. But if na true say the snake swallow the money that means one of the politicians don turn to snake be that o and later e go change to human being after getting to bush wey person no go see am again. Na wetin i fit yan be that o

Thanks for givin me chance to pit mouth on top the matter

NOTE THE RICHES ANIMAL IN THE WORLD IS THE SNAKE WHO SWALLOWED #36,000,000

Hehehehe dem don chop the money.

You dey underestimate the animals wey dey this country oh...see our coat of arms nah, horse dey, eagle dey, e don tey wey dem do dey rule.

Hahaha.. I tireo, e be like say we dey under animal association.

Hahaha! U know say naija too like film trick, e fit no be politician, e fit be person we dey work for jamb office. D thing be say the money don go.
You don try!

Thing wey no fit happen for nollywood na en our politician dey for naija.. We go belief that one. E bad past film trick for movie

My broda! Our countri don turn to cinema.

Lol... Then dey act,we dey watch....

Abio, make we kuku go buy ticket.

No need,den dey do free show for d whole world to see.lol

lol movie dey learn work for where them politician dey

Abi na... No need to think before u go writ script again,just follo naija tori,u go writ a very comic one...lol

Lol, i nor even tink of that one before, na to just day act wetin dey happen for naija film don complete

Lol,naso.... In fact d film go get part 100...

Lol, them go use different names for the different parts

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.12
JST 0.030
BTC 60248.53
ETH 3368.01
USDT 1.00
SBD 2.51