NIGERIA PIDGIN CONTEST....#WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME.

in #npc6 years ago

IMG_20180101_155422.jpg

Friends nah wetin everybody dey like to keep but dey danger wey dey inside, nah him dey some people no dey like to make friends.

For dis edition of contest, I go dey yarn una on wetin friendly enemy don do me but before I go start, I go like salute dey organiser of dis contest @ogoowinner, sister make baba God bless you oo!!

Yeah! I comot for secondary school for 2010 when I write my WAEC finish, I come dey for house for some months wey be say I no dey do anything. One day I say make I comot go find where I fit work dey get small money wey I fit take buy JAMB form when e go come out.

Nah him I waka enter where der dey sale beer for depot, I go meet dey manager, nah him dey manager come say if I fit follow them work, make I come tomorrow but my salary go be #4500 every month because say nah only to dey offload and onload crates of beers go be my work.

I come look dey salary, to me, e dey too small but as be say I no get choice and I no even get anoda place wey I go find work go, I come accept'am.

Nah him I come start deh work oo! After one month dey come pay me my salary, but as be say dey work I dey do dey very hard and dey money wey them dey pay no be say e too big, I no even no dey time wey I take finish dey money wey dey pay me for that month.

So I continue dey work, e get this boy wey me with'am follow dey work for der, him name nah Chinonso. Chinonso na dey only friend wey me with'am dey too close for that place. So one day, I come dey explain to'am how dey money wey them dey pay me dey take finish, say I no like'am because dey thing wey make me dey work be say I need money wey I go take register for JAMB when dey form go come out. As I talk finish, e come ask me weda I fit dey comot #2000 dey give'am make him help me dey keep'am as savings, anytime wey I wan register for dey JAMB, e go give me.

Nah him ooo! I come accept'am, every end of the month, I go carry #2000 go give Chinonso. So nah him, I come dey do'am sotey e come reach five months and dat time, JAMB registration don start, so e come reach Saturday wey be say nah when we dey do last work for a week, I come tell chinonso say I go need dat money as be say dey registration don start, e come tell me say, make i no worry, say e go bring'am come on Monday.

So e come reach Monday, early in dey morning I don even dey where we dey work, dey wait for'am becus I wan use dey money go register for evening. So we come start work dat morning for over one hour wey we start work, Chinonso never come, I come think say maybe e no wake up early for bed nah him make'am never come work.

Nah so we work sotey come reach afternoon and Chinonso never come work, I come dey ask myself weda this my friend dey sick and e no come send message to me, even if to give pesin dat money make him give me as e be say e no fit come.

As we come finish work for evening, I say make I go ask our manager weda e no wetin make Chinonso no come work. As I go meet dey manager, e come tell me say, Chinonso tell'am say, e dey travel to Lagos, say e wan go look for another thing wey e go dey do for der.

Omo! nah him I come open mouth, so Chinonso carry my money go Lagos e no tell me? Wetin I go come carry go register for JAMB nah? I come dey ask myself all these questions becuz I no even fit tell pesin wetin happen. Confusion come enter my head, becus dat money nah dey only hope wey I get, as I finish for work dat day come reach house, I wan cry my eyes comot. I no come no wetin i go do, as e come reach the following day as I no fit endure' am again, I go explain how everything happened to our manager. Nah him dey man come get angry with me, come dey vex, as e come vex finish, e come say make I no worry, say e go give me small money make I find small join'am go register for dey JAMB.

As e talk'am finish, e come warn me, say make I mind dey way wey I dey take dey trust friends.

Thanks for reading;
The picture wey i put nah for Ondo state, i snap'am
images.png

Upvote/comment, resteem and follow @joseph-jnr

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 62808.61
ETH 3464.94
USDT 1.00
SBD 2.53