Naija pidgin challenge: Make una tell us why una like Steemit

in #npc6 years ago (edited)

 Beautiful university of Nigeria Nsukka (UNN) Library 

Hello steemians, happy new week from @ogoowinner


I guess some of you might be wondering what language I used for my topic. Well, it is called broken English, also known as Nigerian pidgin. It is largely spoken in all the Anglophone West African nations. 

Here in Nigeria, more than English, most of us love pidgin and we use as our lingua franca. 

This challenge for our pidgin lovers. I hope you get to understand it and share the fun. 

My Naija people o, I dey hail una. 

I been talk for my last post say we go start our pigin challenge. We go dey do am in different categories. Sometimes me or another person go write for English then the rest of us go translate am to pidgin.

For this challenge eh, everybody na winner o! 

How we go dey take do am 


Every Monday and Saturday go be our pidgin challenge days. E fit come in as say make we translate something or make we just yarn something for pidgin. 

We go always use this tag for our posts #npc (E mean; Naija Pidgin Challenge)

No forget to add the Nigerian tag for your posts o! 

Your post no go dey less than hundred words.

Add picture and description of one fine naija site or person for your post. 

I go dey try my best to always visit una entries. 

So our challenge for today na; make una tell us why una like steemit. 

See my own entry

I like steemit well well because the thing don change my life big time. 

Before I join dem for here eh, Twinkas show me wee. In fact dem pour pepper inside my eyes. Dem carry broom sweep my house just as APC dey do us now. No be only dem o, even gethelp and giversforum join show me shagey. 

But as I join this place eh, everything con change. E no dey easy o, because e get the time wey we dey write sef, we no dey get anything. 

Another thing wey make me like this place be say, e dey help person develop ein sef. I don get plenty plenty experience from here. Even how to make money, maintain good relationship and plenty other things sha. 

The last one be say, as e be say I be dat kind shy person sef,  I no too get friends before o, but this place don make me get plenty  friends, including plenty children wey I don be their mama sef. Lol! 

When I dey cry 3 days ago, na @ehiboss call me dey comfort me sef. All my people for ogoowinner winners forum and my people here show me plenty love. If to say I no dey here na, na who for do all these things for me? My people, I hail una again. 

Na these things and many more make dis place dey totori my body. 

I'll use the opportunity to appreciate all of you who spared your time to  comfort me here as regards to my uncle's death. I say a big "Thank You"  to all of you. 

I'll also like to announce the  winner of the liquid payout for that post. @nmalove helped to pick the winner. The liquid payout will go to @steem-lagos as a contribution to save a little girl's life. 

image source: imgur.com

I remain your lovely and loyal @ogoowinner

@elyaque made this beautiful badge for me.

Sort:  

You too much....i hope the little girl gets well soonest...i dey feel u for dis challenge oo...e make sense die...biko mk i go do my entry shap shap!

madam calm down why you dey rush, this talk whey you carry come make sense like person whey invest for btc, all of us whey be naija go run am as e dey more original than writi writi whey dem oyibo say make we dey do, i go jam you for road now, as e dey go,
marshalllife from the other side.

Chai! dis thing dey sweet my body. Make dem no hear you o! Lol!

lol me i have lock my mouth to prevent stories that touch.

Lit👌👌👌👌👌.... Tanda wait for me.. I go Sama you my own entry soon. Your brain dey dere ooo... Make we jollificate with this correct ogbonge challenge. Doh @ogoowinner

My bro I dey feel you for here well well. Weldon!

You Don finally give me chance to showcase my luv for steemit. I Don Kukuma make dey post see the link here why me too love steemit
Thank you

I happy say you like am. Weldon.

Shuo!!! As the tin be now wey madam @ogoowinner don give somebody like me to show case my talent with pidgin so, I go Mara till I Mara ra on osha pra pra level. I go drop am na na na!

I haf faint! you be master for dis pigin stuff o.

e no easy ooo. Steem show me wen too ooo. He been take like 2 months before I realize say na chat go fit help me https://steemit.chat. I sign up for the chat becuase sign up for there na instanta. I greet people there wella, then I start to complain say I never receive confirmation to join. One person tag me tell me say make I write my complain inside the #help room. One the same day one admin guy contact me. We talk small then, him send me link say make I fill form. After I do am, I think e take less than 2 week na him confirmation land my inbox. I guess you fit say the rest na history. I dey like this site so far even though I no dey make too much right now. But hope dey, my sister, hope dey!

I dey tell you, plenty hope dey. Join the challenge make we start from there.

I give you tiri gbosa for this one ooo my sister. How person wan define impact again na? See as you wan give us small enjoyment from wetin steemit don do for you. Your head dey dere oooo. Me, I love you @ogoowinner. Well done for this one ooo

Thank you ma sista. Abeg join the challenge make we carry go!

I dey feel una dai.. Me sef don drop my own for yonder o! Based on logistics.. I don hash tag am #npc

Omor this your yan go well, accept my condolence based on your uncle death, i dey sure say you been love the man well well.

I stand gidigba for this challenge them.

Thank you. Oya make we run de paro.

Lol, sure things

Wawu!(my own way of saying waoh!). Na dis one den dey call serious matter. Dis your concept na serious business. So make we just dey yarn for our own pidgin. Ok ooooo na @ogoowinner start am o (lol). Good one my personal pesin. Below na my own entry link. I hail o.

Na my entry link be dis o : https://steemit.com/npc/@optimistdehinde/h1-chai-see-as-steemit-don-change-my-tori-ogoowinner-nigeria-pidgin-contest-entry-h1

Just dey fine jo

Na my own entry be this oh
https://steemit.com/npc/@ajremy/naija-pidgin-contest

I hope sey in dey saucy and juicy enough for u

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.12
JST 0.027
BTC 65181.06
ETH 3405.23
USDT 1.00
SBD 2.48