The Creed Of Life. NPC; Episode 3

in #npc6 years ago (edited)

This creed nah beta talk, no be for mouth alone, everybody go take hand join together make dey do as we go take yarn am .
@agoowinner you dey try no be small. I throw way salute give you. Nah so I take talk my own. make una talk your own too.

I believe say nobody wey no get the right to be seen, heard and loved.

I come follow believe say nah all woman bikini dey equal for this world wey we dey see so.

My believe be say this world big so tey in fit contain everbody.

I believe nobody wey no get correct sense for one thing as things take many reach.

I believe say every man bikin dey very special and unique.

I never see person wey no go get beast and angel for inside . So I go try my best say make the beast no for show and make people dey see me as better angel.

I get the believe say anything wey get to do with were you for come from, wetin you believe or how you dey take worship and were you belong for inside society nah things men wey get bad mind dey use make dem for get better control on top dem fellow man. All these things wey I mention dey cause strife even dey make some people believe for their mind say dem better pass their fellow man. Me Don choose to be "human first" before I go allow any race, religion or class follow rub body.

I go make sure I treat people as I go like make dem treat me.

I no go ever do to my fellow man as dem take be, but as I want make dem become.

I no go cook hand for any business or project wey go invite kasala and gbege for another person.

I go strive make I too understand people, wey be say I no go ever judge dem Lia Lia.

Me no go allow envy, jealousi and greediness dey control me like keke.

I go make sure say i accomplish one obonge thing for this world before I for Waka go meet baba God.

I go try make i dey strong even if life carry all in wahala come meet me.

I no go allow fear make in come dey do me anyhow.

I no go allow any negative thought carry chair sitdon for my mind; I go sharperly replace them with thought wey dey very peaceful and creative, because I know say "thoughts get power".

Nah always me go everly dey original, I no go look another person do my own.

I believe say I fit make Correct difference if I carry better hand do anything.

I believe say life no be race but nah journey, so I no go they follow person drag for first position.

I follow believe in peace.

I join believe in charity.

I believe Wella in forgiveness.

I follow believe in love.

I too believe in mercy.

I join believe in justice for all.

I get obonge believe for human race.

I don make final decision make I live life correct and no be just anyhow.

I Olanrewaju Micheal go dey abide by this creed as in take boku reach all the days of my life. Amen!

Make I Sama you the photo of one obonge and correct Nigerian.

Pastor-Enoch-Adeboye-938x535-e1482629079299-487x278.jpg
Pastor Enoch Adeboye. Source, Wikipedia.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 62871.45
ETH 3479.64
USDT 1.00
SBD 2.53