New kasala just bust

in Steem4Nigeria5 days ago

1000123878.jpg Designed with PhotoStudio on GalaxyA15


Kasala want bust


See ooh! Tax Kasala just dey full ground.
Some people just kom komot dey say make that tax thing just wet small, say them no want make any body pay this tax now. Say make Nigeria first fix bad road, light and other things way don dabaru for inside Nigeria before we go kom dey pay-pay tax.
This group say them be The National Opposition Movement (NOM) even Vanguard Newspaper carry the tory

National Assembly kom carry their own chook inside the kasala way don dey ground. Them say the tax law way Nigeria kom they use no be the one way them been approve, say them kon change am for road. May be nah the printer make mistake kom print another thing. Them say make them use the tax law way National Assembly been follow gree, say this one way them dey use nah another thing. Nah so I see am for inside Guardian newspaper.

1000123937.jpg

Like say wetin day ground no thick rich, some people don dey shout say tax office don slap them with tax way no be here, say the kind money way the say make them pay just kreaz.
Sey E be like say them they do like NEPA way dey kom look your house, knack you estimated bill. Say tax people don dey follow use that same style. Say them go just look your company, as the house big rich, them fit just say, pay 300 million, then them go go their office go wait make you kom negotiate.

Another wahala way dey be say, this new law kom give this tax people too much power way them fit kom catch you just because them feel say you no pay tax and before you open mouth talk, you go first pay the money before you talk.

1000124137.jpg
Daily Trust say the kind power way this cut-join law kom give tax people go make them kom carry you anytime go lock.

Hear how them say Am for oyibo grammatical.

“…the tax authority shall have the power to investigate or cause an investigation to be conducted to ascertain any violation of any tax law, whether or not such violation has been reported to the relevant tax authority

and shall also have the power to arrest any person suspected of committing such violations through relevant law enforcement agency.
” – Nigeria Tax Administration Act, 2025 (Official Gazette)

You here am?
"...to arrest any person suspected of ..."

Nah this red side them say them no know how im take enter the law. And im day plenty way dey like that.

Make you pray make tax office no suspect you. Because them fit sale your property sharp sharp take pay tax way them suspect say you owe them.

Some people say them want do protest, other people say, wetin them don sign, them don sign. But you knonw say maybe papa no read that thing way im sign sef.

@alexanderpeace and @ninapenda, I want know wetin you think about this. And I dey wait to hear from @okere-blessing and @sadematthew.

@ruthjoe, @rubee2as1 and @dequeen, wetin you hear about this tax and how you dey prepare?

Media Credit
Composer@manuelhooks
Captured withGalaxy-A15
Posting DateTuesday 06 January
(@) 2026


@bossj23 @josepha @bela90 @goodybest
#steemexclusive #fintech #club5050
#learnwithsteem #education
#taxation #nigeria
#money

Sort:  
Loading...

--

TEAM 8

Congratulations! This post has been voted through steemcurator08 We support quality posts, good comments anywhere and any tags.


1767244330135.png

Curated by : ngoenyi