You are viewing a single comment's thread from:

RE: NAIJAPIDGIN HOTSEAT EPISODE 3 WITH MIMY

in #naijapidgin8 years ago

Naijapidgin i hail una! Make i drop my own now as e dey hot..... You say 👂

@mimy
You make me laf no bi small, watin you con dey think wen you say #mimyindomie? Lols. I for advice say make u open your own #mimyindomie factory. (winks) And again you con dey yarn the pidgin as if you be correct warri babe, abeg no vex, na where you from migrate bcos i know say fine people no dey fit yarn dis kind pidgin wen you scatter for here so?

Sort:  

She no sabi form o. Na as she be, na so she be.

She too much abeg, i hail una two. Nothing go scatter this union, who wan try am na six fit bi that o😁