THIS MAN MUST DIE

in #naijapidgin6 years ago

Thank God say today na Friday. My country people I trowey salute o. How una dey? How una week? Hope nobody make una vex? Abeg anybody wey do anyhow make una show am anyhow.

Okay to the Tori wey dey ground today. I just come back from work na im I hear people dey shout o. They gather one guy just dey knack am left right and center. I say make I go know wetin dey happen o based on say make I still dey updated. Na so I draw near o see the young man as blood dey come out for nose, eye, ears everywhere o.
imageimage

Wetin he do? Wetin he do? Na so I just dey ask before dey knack me the Tori o. Them say na so dey catch the guy dey put im thing inside one 2 years old girl baby thing. As I hear am eh, my brain scatter na so I join the beating o. Na them sef come dey hold me.

Abeg my people, wetin go make full grown man see small pikin wey no her breast, no get yansh no get anything and im thing go stand reach to do? Make una shook mouth put for this matter o.

This kind people so, which punishment you feel say na im dey deserve? If I talk my own eh, but I go let una talk una own first.

If you go like join us for Telegram to win plenty recharge card abeg click here

Na @zizymena carry this Tori come una domot.

image

Na @mittymartz na im help us design this avatar.

Today na Friday o, party jeje

Sort:  

@naijapidgin, me sef tire 4 dis kind mata o,wia old man go dey flog small pikin koboko by force...but d mata na 2 ways sha. u know say oyinbo version dey n black man version sef still dey. Make i try analyse both versions 1st, b4 i make my conclusion.
Oyinbo version make us realise say dis kind thing na psychiatric case weh dem dey call paedophilia. N anybody weh gt dis kind disorder, dem dey call dem pedophile. But my question now na say, wetin dey cause dis kind mumu disorder or au peson take dey get am?
From d black man perspective, na d winch pple 4 d man village dey folo am 4 bak. But mk we reason d tn well tru tru,wetin go mk mature man dey go folo small pikin do dat kind tn wen better babes dey weh set, if d man no fit spin babe sef, red light district dey everywia weh e fit just enter,pay money n free him waist.
But na my own point of view b dis sha as peson weh go skul small, dem suppose chek dat kind man brain tru tru weda e dey ok as dem talk say na psychiatric disorder, anytn dem come out with, mk dem use attend to d man, mk we no dey attach evrytn to winch mata, n also mk dem try rehabilitate d pikin weh dey get dis kind experience mk d trauma 4 no affect dem truout dia life.
@naijapidgin, i hail o....

you are very funny...lol

Hmmm.. this mata don tire person o...those kain yeye men full everywhere now..my own be say make dem dey castrate anyone caught in the act. Whether na mistake o or na spiritual problem or psychological problem, castrate them..chikena

Omo,dis babe bad o,u no just get mercy at all...anyway sha,evrybody get dia own sense of judgement...mk Oluwa help us all...

@ilukzymore I tire for the matter. Red light street true true full everywhere. You support @ponmile for wetin she talk?

@ponmile judgement style too bad o,e over harsh sef. Y d mata need enuf sense to handle na say, smtms e no dey b as we take dey see am...so me no agree at all o, castration too harsh abeg. Wetin dem go do old women weh dey harass under-age bois too? Dem go remove dia p***y too?

I buy ur idea jare @ilukzymoore, na everything be spiritual for this part of the world and e no suppose be so...
I no Dey dispute d fact say e fit involve some fetish things, but then, e fit still b dat psychiatric disorder... When dem discover say no b disorder, dem fit come send dat kind man to prison and make dem no forget to do something to the pikin psychological state make d thing no go haunt d pikin truout ha life...

Your head dey dia jare, one of the reasons y africa dey bak na cos we dey look everything from the wrong perspective, come apply wrong methods to get wrong solutions....

Me feel say mk dem go check DAT guy psychiatric and psychological state. He is very sick aswear...

I concur folo ur judgement sha, weda physical or spiritual or psychological, dat guy no dey ok, e need attention...

bad bad tins done full this word. Make baba God just come, na wetin make we dey pray for be dat o

Ameen but make he wait small make we manke money😁

ok o, even with the moni know peace.

Hmm this tori dey scratch my ear, I no no how I go take shook mouth for this tori. anyway, this man deserve plenty punishment because if you leavam go free em go still do wam again

Which Kain punishment go good for am pass

Babalawo spiritual kain

The best thing na to carry petrol pour the yeye man, abeg who go borrow me matches?

Abeg I get matches

The thing tire me o my brother and tori like this don plenty for our country. I no sabi wetin grown man dey find for small pikin thing. Na to put them for life in prisonment go sweet them jare.
I dey hear say na psychiatric disorder dem people like this get. As dem dey do dem jail term make psychiatrist dey visit dem too and people wey think say dem get tendency to become paedophile make dem go visit psychiatrist.

You yarn better no be small. Person wey him sense correct no go try that kain rubbish

Na so ooo.friday tin club flexzing.the tori get leg oo,the mata heavy for my mounth.waitin i see be say our thin no get respect him dey give us standing ovation when we no expect.him no dey mind weather na small pikin or mature ekele.him go push you to crab an chuk

That thing must get respect for small pikin. Wetin? If na your 2years old pikin you go talk say make Dem leave am because e no get respect?

my pipu, I greet una well o
as e b like dis eh
for the man to insert e big sim card for the girl small sim space, this one show say the man no get wetin oyigbo people dey call conscience.
two years old baby, my pipu e fit be curse o.
how grown man go do that kind tin with e clear eyes. When grown up girls plenty for the country.
The punishment simple.
Na to castrate the man....

The sim card levels make me laugh no be small. I believe you die. Na to comot him sim card na e be best punishment.

Na just to comot the man sim from the baby phone break. With dis,d man go dey offline for life

Hmmm! This one na pure gbege o.
Me i still shock for this tori o.
If na make i talk my mind, i go tell you say this matter no be as we seeam na em dey. Me i beleieve say e get wetin dey nak music for the bird wey dey dance near the bush. Like my fellow steemian @mike4christ talk am, na so i seeam o. I dey see that gbege as spiritual matter o. That thing no be anyhow thing wey we fit understand any how.

But my own be say, as i see say that thing fit no be matter wey dey physical,

na to handle that man with koboko. Then after em don enter am finish, make them carry am go meet a true man of God wey sabi God well well make em hammer am with prayer. Make we see whether em fit be delivered.

For me o, i no support say people go continue dey beat am with hard objects make em no die.
Na my own i yarn o.
Well done my country people.

na tru yarn you yarn my DEAR, una no sey before something go happen for physical, edon first happen for spiritual, that matta no be eye to eye matta, so to solve am, na spiritual koboko(advice and word of GOD) na him dey feet take flog the guy o, if una go flog am with physical koboko and the guy come die, my hand no dey dere o

Una do well as una shook una mouth for this matter

you see eh, many many things go cause wey go make the guy go do that kind thing:

  • e feet be say the guy na yahoo plus and baba wey help am do the jass dong tell am say make im go sleep with 2 year old pikin.

  • second, e feet be sey the guy no sabi toss woman and dat thing dey hold am, so as im come see the small pikin, im come dey force am as im know sey the small pikin no go feet talk or do anithing.

  • eh feet be sey that think dey hold am and im no get wife, and no money to take enter where ashawo go feet settle im matter, so im come see the small pikin, and come force am do am like that.

but for my own side, I go say make them forgive am and advise am, make im no do am again because person wey be saint today dong be sinner before, and person wey be sinner today feet still become saint tomorrow if they give am chance make im change(no be that change wey our Nigedia contry dey do o)

na weting me feel sey go make am go do that kind thing be that o.

ME DON TALK MY OWN, YOU SEF TALK YOUR OWN MAKE I HEAR TOO

If he come do am again nko?

lia lai, he no go feet do am again, if dey dong advice am well well, he no go try am.

As I hear am eh, my brain scatter na so I join the beating o. Na them sef come dey hold me.

If to say i dey close to you, I for borrow u extra Motar -pistle, make u use pound him head.. 😂

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.13
JST 0.033
BTC 61915.54
ETH 3000.10
USDT 1.00
SBD 3.59