NPC pidgin contest,making steemit more better

in #npc6 years ago

@ogoowinner ,the ogboge naija pikin wey they make naija better,you dey help rebranding the language wey be say na em connect us together. Na every tribe for naija fit speak and understand am well well. I salute you oo

Here is my entry to the tori wey dey for discussion today

Since i joince steemit i just they observe some things oo, i no no say i go get opportunity to talk on how to improve steemit,sincd you don give us the opportunity for una contest,na so i go talk weting i know.
For steemit,we suppose have a standard minimum but not d maximum number of words wey we must write to make a post,d wey people they write shikini tori call am post they tire person. Some people go write for steemit as if dey day for twitter dey expect upvote. I no talk say person should write long jaggons but,the thing should not few lines post

Another thing be say, the bandwith should be increased,the way prrson dey exhaust an sharperly dey pain person,like you talk am for ya post @ogoowinner say u no get enought voting power to dey vote every person wey participate for ya contest,if people like dey complain,waiting people like us go do? So make them increase am small

I ather thing be the issue of comment,some persob comment no go relate with person post. E get one time wen i write about naija tori as e dey hot,i com ask people make dey contribute for the matter,na one person com comment 'nice post' me i never waiting nice about the post ooo. If get a way wey b say you no fit comment anything if you no read the tori,e go better.

Na here i go stop small jawe,
God bless naija for us.IMG-20170421-WA0001.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.030
BTC 68688.65
ETH 3764.71
USDT 1.00
SBD 3.51