IF E NO BE PANADOL, E NO BE PANADOL.

in #npc8 years ago (edited)

naija-love-1.jpg

POEM IN PIDGIN, PASSIONATE NAIJA

If e no be panadol, e no be panadol
I been dey wait to see you
I don chill wella to meet you
My soul sef dey para say I must love you
I try use drugs, but girl none fit cure you.

If e no be panadol, e no be panadol
How person fit get you, this rare commodity
I go pay big money to maintain sanity
Dem plenty out there, nobody fit match your originality
I dey ache, dey feel tingling for this your personality.

If e no be panadol, e no be panadol
I don hear plenty about you
Na everytime people dey talk better about you
Dem dey talk about your serenity and originality
Dem no fit carry mouth commot for your serenity and originality.

If e no be panadol, e no be panadol
Others na panda Dem be tramadol
Since I don meet una, just a tablet prove me tall
You be right medicine, after all
If e no be panadol, e no be panadol.

Shout-out to my big bruh EMMANUEL BRENDAN (EESTINCT) for inspiration, the poem sef dope in English. Boss i hail o.

Me @kolapo1 drop this piece for una this morning. Shout out to @ogoowinner for her pidgin initiatives, and others supporting her.
Hope y'all love this o😁😁😁