THE CREED OF LIFE, NPC EPISODE 3 (MY ENTRY)

in #npc8 years ago

My good people of Steemit, I greet una, as we dey enter episode 3 for this our ogbonge NAIJA PIDGIN ENGLISH CHALLENGE, I dey throw way better salute give @ogoowinner for her better better initiative them to make Steemit make e grow for we country Naija.

image
SOURCE

.

Na here I want come give my own life creed:

I believe say every person get right make them see am, make people hear am and make them love am.

I believe say every human being dey equal.

I believe say this world bid reach to contain every body.

I believe say every person na guru for at least one thing for this life.

I believe say every person wey dey this life dey special come unique join.

I believe say every person get him own animal wey dey live inside am come get him own better person inside am too. So me I go try make I control the animal allow the better person make him show.

I believe say race, religion and social status na nothing but but na men wey there own no good create those thigs make them use an dey control other people, cause wahalla come plant that mind of I pass you I pass you inside people. Na him make me I decide say first first, I go show say I be human being first before I come join any race, religion or class.

I go treat people as I go like make them treat me.

I no go react give people based on who them be, but who I go want make them become.

I no go put hand for any business or project way go cause harm give another person.

I go try well well to understand people no be to judge them.

I no go allow envy, jealousy and big eye make e control my motives.

I go accomplish at least one notable thing for humanity before I go leave this earth.

I go try my best make I remain strong even though I dey face misfortune, grieves and sorrows.

I no go allow fear to intimidate me.

I no go allow any negative thought make e occupy my mind; I go carry peaceful and creative thought replace them sharp sharp because I know say with "thoughts dey powerful".

I go always be myself, my original self and no be another person photocopy.

I no go take wetin I get dey brag give my neighbour.

I no go dey talk bad bad things against my brother or neighbour for him back.

If my neighbour do me wrong I go call am face to face, tell am then I go forgive am.

I believe say I fit make a difference if I put in my best for any task wey dem give me.

I believe say life na journey no be race, so I no go permit myself make I enter competition with person.

I believe for peace.

I believe for charity.

I believe for forgiveness.

I believe for love.

I believe for mercy.

I believe make justice reach everybody.

I believe for human race.

I don decide to "live" no be to just dey "exist".

Me KINGDOM CHUKWUDI go do wetin this creed talk all the days of my life.

The image above is Herbert Macaulay a foremost Nigerian nationalist.

Sort:  

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by royaltiesboss-eu from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

Coin Marketplace

STEEM 0.05
TRX 0.29
JST 0.043
BTC 67715.88
ETH 1969.01
USDT 1.00
SBD 0.38