The Creed Of Life. NPC 3

in #npc6 years ago

My Country People, una weldone oo. How e dey be for una side? I no say una flex una Sunday well.. Nothing do Una just flex tight.

images (1).jpg
Image Source Una sabi as e dey go naa say anytime wey I dey raport for pidgin, Na im be say @ogoowinner dey for my back so I want first comot cap give her. @Ogoowinner You too much joor. After you na still you.

Wetin I get for una Na creed of life dem dey call for English but I go do am for pidgin.

Me gan like this eeh, I believe say everybody get right make dem give them listening ear and see wetin dem dey do then come Love dem join.

I believe say everybody for this world dey the same level. I know say na everybody when dey this world, no body suppose important pass each other. Nobody better pass anybody here wey we dey so make we calm down no dey carry shoulder up.

I believe say this world wey we dey go enter everybody so make we no dey jealous ourselves.This world dey big sotey e fit contain all of us wella. Shine your own make I shine my own.

I believe say everybody get Wetin im sabi do well. Something wey be say if him no sabi am, nobody else go sabi am.

For this world we dey outstanding.I believe say all of us dey special oo. No one of us dey anyhow. You no fit be like me and I no fit be like you so make we no try be like another person rather make we try be the best version of ourselves.

No forget say race wey we come from and religion wey we dey practice Na wetin people create to use dey control us. Na some people make am so that them go use am dey wicked others so make we try get human mind first anytime we dey relate with person.

For this life, I go dey treat everybody the way wey I want make dem treat me. I go dey relate with people fairly. So E go be do me I do you.

I no go dey do selfish business wey go profit me alone then my person wey I do business with go come lose. It's very bad.

I no go allow fear fuck up my style.

I no go dey judge person on first sight. I go try know wetin make the person do wetin him dey do.

I no go dey jealous my neighbor for him business and before I comot this world, I go do something for mankind.I go make sure i do one over correct thing for pipu, b4 i waka go meet baba God. Something wey go help make people life better.

For this world, I go remain original. I no go do something because say person do or say I wan be like the person. I no go follow follow anybody. I go do am because e good.

I believe say I fit change and improve the world make am better place with my creativity .I believe i fit change matter if i reason am wella and put correct work inside and I no go allow make negative thoughts discourage me.

Finally this life no be competion so make we take life jejely because everybody must achieve something.

I believe for Justice.
I believe for Love. Love is the greatest.
I believe for Charity
I believe for Peace
I go begin live dey impact lives no be to just exist.

I @udembaselfmade go dey abide by this creed all my life.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 63079.17
ETH 3466.92
USDT 1.00
SBD 2.51