I Win Something from @destinysaid contest.

PicsArt_10-21-12.21.42.png

I Greet every body wey carri dia time read dis post.

My body dey sweet me now as i dey write so, i no believe say me self fit win somethin from dis @destinysaid contestScreenshot_2017-10-21-14-09-17-1.png
You fit go read am for here

Di time wey i join steemit world, e dne dey nack like 3weeks now wey i join. I still be new comer dat time as i neva sabi wella as e dey go here, na so i cucuma use je-je dey stroll for inside nigeria tag dem. Dey talk for post dem wey i like, till i com jam one post like dat wey @destinysaid post, the topic na My life as a producer #3 & enrouth to Lagos Day 1 : The long distances, luck or higher power!

I see sense for the topic, na so i begin read Di post as e dey talk how he hustle be and how street be inside lagos, i com jam the area wey he for talk say he congratulate us wey read reach dis part,

Congratulations! If youve made it this far, youre one of the few who read through the whole thing, . . . or you just scrolled to the end. Either way, im giving out 10,8,7 SBD in that order, to 3lucky participants as part of my 800 followers celebration.

Here's what you need to do.
Write for me, in less than 300 words, in the comment section below, what being african means to you.

See, simply and to the point.

Best answer gets 10 SBD
2nd best gets 8 SBD
3rd best gets 7 SBD

The only rules are that you should place it

He say e dey celebrate sey 800people dem don dey follo-follo am here, sey e go-like dash 3people wey get luck sbd.
He sey e go dash peson wey carry 1st 10sbd, dash peson wey carry 2nd 8sbd, com dash peson wey carry 3rd 7sbd.

Sey make we talk HOW WE SEE AFRICA?
unnamed (3).png
See wia i collect Dis picture

As i be original Africa man, I come talk my mind how me take see am for my own eyes.
Screenshot_2017-10-21-12-43-02-1.png
see my own reason

@destinysaid on the beat, make i talk my own mind,

I be black man from Africa and
Original Africa man na black, and black na Original.
After asia na Africa big pass for dis world.
Africa no dey play with dia culture.
Africa na pipu wey believ juju dey, and na dem still go church pass.
Africa political system na wayo but we still dey survive am.
wetin fit kill one africa man fit kill two oyibo man.
Inside Africa na Nigeria be the Giant.
And na Nigeria my mama and papa come from, so i get right well-well for Africa.
So if u be Nigeria you be Original Africa man, no fear.
As Nigeria no dey carry last
Any place wey u go for dis world if you no see any Nigeria man dia, just run for your life ooo.
Make i stop for here

If you be nigeria you be original Africa man.

You Still fit see am by your sef here

As i come back online yesterday becose i been no dey online for some time, i come see 7sbd alert for my wallet, na him i check he come be say na @destinysaid send am give me, i come begin wonder how come? i come see congrate sey i carry 3rd for he africa competition
Screenshot_2017-10-21-12-34-24-1.png

I come go check come see sey na
@ambmicheal carry 1st
@tezzmax carry 2nd
Screenshot_2017-10-21-12-33-51-1.png
I happy wel-wel oooh because i no know sey me sef follow for winner.

I wan use dis opportunity thank oga @destinysaid wey pick me join people wey win, 7sbd for dis buhari season no be mai-mai

I thank @ogoowinner wey dey support me join @churchboy dem @michaelcj dem, i troway salute for all boss dem wey gather read my post.

Thank you

IMG-20171012-WA0016.jpg

Make you dey read my post if you gbadun me.

Sort:  

E be like say Flag dey hungry you. Smh

hahhaha! abi? shey e even read di post self? Abeg pitty am small

Hahaha. Omo matter eehhh. How area Na? What of omotogbe? Boys just dey here dey confirm u. Abeg no forget to send my share ooh. Na eyesaw.

Eye wen see must to chop. Lolz

boss boss, you na our sheperd here. you get mouth like gun.

Congrats.... I gbadun u and I Don read your post

thank you. make sbd fall ontop you my sister

Oya Now, I enjoy your tori. I been follow compete but na you get am. You be winner for body. Well-done Jae.

all of us na winna. na di people wey dem won give am bro. Na Una try pass

My brother, see as you just dey make small man big. Me be no dey online since I enter bus go Lagos. I just come back yesterday come say make I peep here small, na em I come see you. I be no wan talk but I come see say Owerre people right when they talk say As peson dey peep, en head go dey show. As I peep so, your tori come sweet me and I no fit jus pass like that, na so my head con dey show. Congratulobia bros mi. E no get sonethin wey I no fit do for you :)

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.16
JST 0.029
BTC 64487.39
ETH 2635.06
USDT 1.00
SBD 2.80