REMEMBARANCE: Some Kind play wey We play As pikin wey dem born for Nigeria

in #pidgin-english7 years ago (edited)

My people for steemit, i dey greet all of una. I don dey miss una well-well. As e dne tey wey i show here last.
I wan remember una all the kind play-play dem and some kind thing dem wey una go don dey forget by now, wey we go like to remember back.

I sabi sey most of us go done marry, born pikin, get money, dey hustle for betta tomorrow. All dis challange com make us be like say we dey forget all dis our sweet small pikin memory wey i wne remember una so.

We sabi say the time wey we small, we dey pray make we grow up sharp-sharp, make we fit dey do wetin big people dem dey do. Now we don grow up come see say na alafia we dey chop wen we still dey small, sey life no eazy atall cse challenge wey dey for big people too much, He come be like say make we turn pikin back, But no wahala sha we go overcome am.

If you grow for nigeria na im be say you follow enjoy your small pikin age well-well pass for dis world.

Make i start to dey list some betta-betta play wey we play wen we dey small

Rubber-band: this one na like gambling for where naija pikin dem dey. Ruber-band na one tough game wey be say guys dem go dey challenge with rubber band.
Una go stand for desame line begin throw rubber band, to where una gree say e must reach so any body wey play he rubber, come cover another one, na him be say he dne chop all de rubber wey dem don throw for dat round, e go begin pack am.
Rubber band get plenty different style to play am, e depend de style wey una agree to take play am
This game na like gambling if dem chop all ur rubber you fit cry, or fight sef.
Na game wey be say guys go set like plenty rubber for ground take challange dem self,
Na game wey be say if you chop plenty rubber u go fit still sell give other people.
Na game wey be say guys wey dem send to hawk go just drop dia market for ground begin play am.
images (5).jpg
I collect the picture here

Boju-Boju This one na nigerian version wey oyibo people dey call Hide and seek. Dem go bring one peson out tell am say make e cover im eye den de other people go run go hide, After dem hide finish, The peson go ask make e begin come? if dem say yes the person go begin go dey find dem, Anybody wey him catch, na de person go get turn to begin find people d next round.download.jpg
I collect the picture here

Tinko-Tinko This one na anoder betta play wey girls dem like well-well. Na game wey be say 2people go face them self begin throw desame-desame hand and style as dem dey sing the music wey dey follow am come. This play dey sweet die, because if dem dey sing, the hand wey dem dey throw dey clap better clap wey dey match the music.
Anybody wey no throw de hand wey him suppose throw de time wey he suppose throw am, Don fail be dat.
maxresdefault (1).jpg
I collect the picture here
images (7).jpg
Ten-ten: This one na another play wey girls dem like well-well, Them go draw like 10 lines into two different place, come choose partner, choose leg, one go choose desame leg, one go choose different leg. come begin clap and begin throw dia leg.
If dem throw desame leg, person wey choose desame leg go shout de lane wey e patner go enter,
If dem throw defferent leg, person wey choose different leg go shout the lane wey e partner go enter.
Na so dem go do, till one peson go win.
Na another game wey get challenge.images (6).jpg
i collect the picture here

Police and thief This one na another better play for the boys dem, wey be say some set of boys dem go dey form thief, others go be police.
So those one wey dey form thief, go thief something, Play-play one ooo, no be original thief ooo. Then the one wey dey form police go begin find dem to catch dem.
images (9).jpg
I collect this picture here

War film: This play na hard boys game ooo, This play dey always serious pass if we just watch one touff war film finish like dat. Na play Wey be say boys go use stick take carve gun come arrange dem self run enter uncomplited building or any place to fit hide, begin find them self any body wey first do kpo sound don kill the other person wey e do kpo sound give.
This play dey very rough ooo, we go dey serious like say na real war we dey fight, To de extend say if dem shoot u, u go fall like say u be mango tree. you go lie down dia till that round finish.
maxresdefault (2).jpg
images (10).jpg
I collect this picture from here

I thank all of una wey comot time read my post.

I Thank all of una wey been dey support my posts.

Abeg you fit support dis one too with ur comment and ur upvote.

Thanks from una man @ionlyspeakpidgin

IMG-20171012-WA0016.jpg

Sort:  

U do well o as u do make I smile . those days I b main actor

hahahaha. you self understand. u follow game

Na so ooo

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.16
JST 0.029
BTC 64487.39
ETH 2635.06
USDT 1.00
SBD 2.80