LIE WEY DEY MAKE DEVIL BOW

in #naijapidgin7 years ago (edited)

DQmQ2FzwofMUx4b5SLxs6d55uQgurie5pT6BckkwmvPkFQL.jpg

I greet una my country people. How una dey today? I trowey salute give una o. We don come again but before we yarn today matter we go first announce people wey win our recharge card yesterday. Their names na @mike4christ, @matadonis, @princefizzy and @diamondrich. Una congratulations o.

I no say una go like make una win too, oya follow today Tori.

Today we dey talk about lie wey dey scatter brain. E get some people wey if dey lie give you, you go know say devil na learner. Their lie fit make you run mad. We no dey talk say lie good o, but we just want use this one learn the kind yeye lie wey people dey lie.

Oya wetin you go do?

  • Go comment section
  • Talk one bad lie wey you lie
  • Talk wetin make you lie that kind like
  • They catch you for the lie?

Person wey im lie get highest upvote and comment inside before 7pm this night na Dem go win our recharge card this night for telegram by 9pm

How you go chop that recharge card

Join us for out telegram group here na there we go talk who win the recharge card and collet your number

Na @mittymartz bring today tori for us and na @zizymena edit am

IMG_20180223_122656_371.jpg

Avartar designed by @mittymartz

Sort:  

My country people for obodo naija pidgin i drop my salute o... I know say to lie na bad tin and e no get reason wey de enough to justify your lie. As human being at one point in time we go gat lie. So today i wan share one lie wey i drop wen i de small.
When i enter JSS1 dat year, i been de play like say tomorrow no de. Base on say i feel say na like nursery school wey you go just use intuition take pass. As result comot for first term, i fail jack leg. Na so i blow lie give my parent say na government the compile the result say dem neva release am because na government school. With de hope say i go pass for second term. Second term come worst i fail again. Na de i go report myself o... I chop beating that day sha, but after that na so mumsi keep me down drill me, the next term and the terms ahead i did excellently well.

The moral lesson be say lie no the help, if to say i come out plain i for no fail again and i for no chop that beating because them no flog me because i fail na because i made them look like a fool with my lie. So na so the tori be, no matter what make you try talk the truth.

Ewo, chai! U dey lie for africa ooo, meself don lie but i never reach ur angle oo as per say u come carry government join, ur lie get degree,i dey tells u, nah angle 360 lie be dis oo...

To talk tru, lie no good at all for persin body, maybe dem no kooku ma flog u - ur body go still dey catch para. U understand?

Haha... U chop beating... Na de dividen of lie be that na.

Ur lie carry weight joor...

I troway una mopo salute oo, I use soljar slap folo am up.

D tin be say I no sabi lie, even if I try to lie, I go talk true.
D tin be say, I been tell bros J disciples say E get ordenshi, E go enter ground, come out again. Dem no been believe me.
I been yan Akeem say igbo no good, e no believe me till hin go gaga.
D tin be say, I be wan join una telegram, but my Tele (TV) na 42 inches instead of 42grams.
Abeg send SBD, who card help

My country pipu I salute una o
@Zizymena-eu and other people of dis great house.

To lie no good o, sometimes Na the easy way out.
Some people sef no dey too like truth, if you tell them the truth them go see am as lie and if you tell them lie Na truth be dat for their side.

the lie wey I no fit forget Na the one wey I pour out to my big brother when I dey for my final year for obudo-naija university.
The department wey I finish from wey b geology, we d get special field trip to different regions of we country for mapping. This field work Na once for every session.
As student wey I b as if then, money b dry pass roasted old corn.
I no get other choice than to tell am say my department get field trip wey I need pay certain amount of money. Him no say e b Don pay for field trip for that session and we b don come back.
The guy ask me about the one we go before... I tellam say we be bring the wrong samples come back. The guy bring the money sharp sharp. E no wan hearsay e brother get extra year for school because of #20000.
I no no say the guy get doubt for the matter.
after two weeks, the guy no see my pictures for facebook. Problem start, I come lie another to cover up. But nothing come out.
the guy Don catch me be say e don catch me. Na so the trust d guy get for me disapear.

Hahahahah
I no dey lie oo, i dey fear to lie self.
Cos no lie way i lie, my mama go cash me.

He get one day like this, i wan follow one of my friend go out and my mama no go wan gree.
Na so i compose myself tell her say i wan go one steemit meet up (she knows about steemit). Say all of us for that area one gather. Na so she allow me go.
When i come back, she con dey ask for picture to see the meet up, me con tell her say we no take picture oo. She con see say na only me and my friend picture dey the fone. Hahahaha. She catch me red handed, say i no go meet up say na flex i go flex oo.
Hahahaha

But i enjoy myself sha😀😀

this tori today sweet me eeh, and i gbado una way wella.
My own lie wey i lie wey fit make crayfish mess be those days of blackberry phone.
I buy bold 2 come use am impress one babe wey dey do small shakara for me. As i show am d phone she shout come say i be big boi. now comes my lie; i tell am say the phone fit waka come to me if i dey parlour and the phone dey room dey charge.i tell the phone fit snap pesin, en go naked. Omo this babe believe me oo, come yakata for me.
Na later after two years she come catch me say i be better liar, but d deal don happen ma people.
E get lie wey pass lie oo. Una weldone oo

u can lie oo....
Choi

Omor this your lie fit melt this earth sef. Oga na this your kind lie dey make devil bow true true...hehehe

Although me know sabi lie sha, for that area i be learn. The highest lie na to pretend say I they sleep, where as na lie lie sleep.

Hehehe! Me sef wetin i wan yarn again. Lol. This post sef don dey make my bones break for here o! Lie wey dey make devil bow Lol. Chai! But atimes we can blast lie o. E get one kind lie wey i blast give my uncle tee tee when i come holiday for em house when i was younger. Me sef lie that lie dey feel say i be sharp guy not knowing say i don f*ck up big time. I come my uncle house to spend some time na em i fall hand. As olodo wey i be, i no come settle to observer the environ wella before taking some funny moves. Na em my uncle commot one day leave house for me. As a sharp guy i bounce enter em room go arrange cut him cake the way wey him no go fit find out. Joinam small tea and milk for my cup. I do am any how with cold water sharp sharp come carry yansh sit down for one chair for the room balance. I consume my spoils finish, arrange everywhere comot. Na em my uncle come back come call me. Asked me how i take stay for house that day, na em i acted like say nothing happen. Na em my uncle over look me enter room. Em no reach 20 minutes my uncle called me inside in room, open in Laptop, na em i begin see everything wey i do for em room. I wan fly as everything dey happen. Na that time i begin start minding my business for that house, not knowing that secret camera(cctv) even dey his room and some coners for em house wey i no even imagine.

But shaa, the reason i fuck up like that sef na hunger and lack of maturity.
Any time i remember that, laugh go wan carry me. My naija people, lie no good at all.

my people Una Welli done o...
how Una day de go nah?
hope say all this plenty plenty go slow no hold Una for road,
This one na ogbonga matter o.
I Don think lie wer I Don lie but I no remember, sake of say if i lie thy must catch me because my mouth go de shake like snake were swallow crab.

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 63776.94
ETH 2629.94
USDT 1.00
SBD 2.84